Emotions full ground as Serena Williams wave bye-bye to di US Open - and her ogbonge career - afta she lose to Australia Ajla Tomljanovic on a trilling night for New York, BBC reported.
Williams wey go turn 41 next month, expect am to be her final match.
E go di end a 27-year professional career, wey bring 23 major singles wins and make many pipo label di American as di greatest of all time.
Williams lost 7-5 6-7 (4-7) 6-1 and tears begin run comot her eyes afta she lose.
Di former long-time world number one save five match points for wetin prove to be di final game but dey powerless to stop a sixth.
Almost everyone wey fit, stand to dia feet wen she comot di court on Arthur Ashe Stadium.
As she wave goodbye and give her signature twirl, Tina Turner pop classic 'Simply The Best' begin play loudly for di sound system.
Wen dem ask her if she go reconsider retiring afta her performance dis week, Williams say: "I literally dey play my way into dis and dey get beta. I suppose don start sooner dis year. I don't think so, but you never know."
Williams dey full wit emotion when dem interview her for di middle of di court, she thank her family, team, di crowd and her fans across di world for dia support ova di years, according to BBC.
"I thank everyone wey dey here, wey don dey my side so many years, decades. Oh my gosh, literally decades," Williams tok, wey play her first professional tournament as a 14-year-old for 1995.
"But everytin start my parents. And dem deserve everything. So I dey really grateful for dem.
"And I no go be Serena if my [sister] Venus no dey, so thank you, Venus. She be di only reason wey Serena Williams ever existed."
Tomljanovic, wey don move go di fourth round and go play wit Russia Liudmila Samsonova, hail her opponent as she take di microphone.
Di world number 46 produce one outstanding performance to block out di noise and sense of occasion wey show for her clinical hitting for di final stages of a brutal contest wey last for three hours and five minutes, BBC reported.